CO2 wey dey comot from Mount Etna volcano no plenti pass di one wey human bins dey produce

CLAIM: One post dey trend for Twitter, where one Archie tok sey di carbon wey dey comot from di Mount Etna volcano don produce plenti carbon and oda harmful gases pass di ones wey human being don dey produce since dem create dis world.

Di post first comot for internet on May 24, 2023, afta one volcano bust for mount Italian.

TO CONFAM DI TOK: Mount Etna na active stratovolcano area for di east side of Sicily, Italy. Stratovolcano na volcano wey dey start small small before e go come rise begin comot liquid fire. Dis area dey di city of Cantani, between Messina and Catania. Mount Etna dey above di convergent plate margin wey dey between di African plate and di Eurasian plate and na di tallest volcano for Europe, about 3,329m high, even though e dey different from di ones wey dey bust sometimes. Na di highest peak for Italy, south of di Alps.

Officials of di Italian Institute for Geosciences and Volcanology tok sey dem bin notice plenti volcano activiti for Mount Etna for Sicily on May 21. Becaus di volcano bin dey comot noise wey loud like sey na bomb togeda with ash wey change di colour of di sky, di Catania Fontanarossa Airport (CTA) bin no fit operate again sotey plane no fit land or take off.

VOLCANO AND CARBON WEY DEY COMOT 

Volcano na opening for di surface of planet or moon wey dey allow material wey hot pass im environment escape from inside comot.  Wen dis material escape, e dey cause am to bust. Anytime wey volcano bust, dem dey join di mata with climate change sake of sey e dey comot CO2, (and oda gases) for di air atmosphere.

According to wetin scientist and experts for di volcano mata tok, di tins wey human beings dey do, especiali since di industrial revolution, don comot plenti carbon dioxide and oda greenhouse gases for air wey you no fit compare to di ones wey volcano dey comot. Even though volcano mata na natural process wey dey affect di earth climate, e no explain why evri where don hot pass for di last centuri, which na becos of human bins.

NASA, one US agency, tok sey di way human activities dey add to di carbon for air dey 100 times more dan wetin dey comot from all di volcanoes wey dey di whole world.

Scientists from di US Geological Survey show sey di annual global CO2 wey dey comot from both lane and submarine volcanoes na from 0.13 gigaton to 0.44 gigaton. Dis amount dey small compared to di CO2 wey human activitis dey produce.

For 2021, one informate from di international Energy Agency ((IEA) tok sey global CO2 wey dey comot from di energy combustion and industrial processes alone don high reach record of 36.3 billion toones(or gigatons.) Anoda informate wey di IEA publish show as di CO2 for air dey increase since 1899.

According to Reuters, Boris Behncke, volcanologist (pesin wey dey study volcano) for Italy Etna Observatory for di National Institute of Geophysics and Volcanology(INGV), tok sey volcanoes dey only contribute small percentage to di CO2 wey dey air compared to wetin human bins dey do.

Im folo add sey di tins wey human bins dey do wey dey make CO2 increase wella for air don increase in di last 10 years but no bi evriday volcano dey bust.

FINAL TOK: Di claim wey sey di CO2 wey dey comot from Mount Etna volcano don pass di one wey human bins dey produce NO BI TRUE.


This content was produced with support from the Independent Media Response Fund, an initiative of the Check Global Program at Meedan to respond to global challenges through hyperlocal initiatives. The fund is supported by the Swedish International Development Cooperation Agency (Sida).

Share your love
Facebook
Twitter

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

4 × three =

Newsletter

Follow Us