Na true sey e dey illegal to travel go Antarctica?

For instagram, one social media user tok sey na crime to travel go Antarctica

Di Instagram post tok sey: “You tink sey na di reasons why na crime to go Antarctica?”

Di post don get ova 26,900 likes as of di time of dis repot. For di video post, you fit hear one man dey tok sey e get old tribe of some human beings wey no dey normal, dem get big angular heads, pyramids and hidden tropical rainforest for Antarctica.

But e no get any correct informate wey show sey pyramids and tropical rainforests dey Antarctica.

Di National Aeronautics and Space Administration (NASA), one independent US agency wey dey responsible for di civil space program, aeronautics and space research, get plenti satellite foto of di kontinent wey get ice all ova for dia website and none of dem show pyramids or rainforest.

Antarctica na unique kontinent for di southern hemisphere wey no get any bodi from dat side. Na di fifth-largest kontinent if you dey tok of area and e big pass Oceania and Europe.

Even though kontries no dey Antarctica, seven kontries including France, Argentina, United Kingdom, New Zealand, Chile, Australia, and Norway dey claim land for dia.

But na true sey na crime to visit Antarctica?

TOURISTS  DEY VISIT ANTARCTICA EVRI YEAR

Since 1950, di nomba of pipu wey dey visit Antarctica dey add evri year.

If you look di informate wey di Secretariat of di Antarctica Treaty provide, one part of di Antarctica Treaty Consulative Meeting (ATCM), you go see sey di nomba of pipu wey visit Antarctica during di 2019-2020 season reach 74,000.

To visit di kontinent, e get some rules wey pesin suppose folo, and some of dem na to make sure sey you no scata di places wey don dey since, make you no disturb dia animals, and make you no cari anytin wey bin no dey dia before come.

To add to dis tok, di kontris of di pipu wey dey travel go dia also get dia own rules depending on di kontri. For example, American pipu wey dey plan go Antarctica first supposed give di state department like three  months notice before dem go start dia journi.

FINAL TOK 

E no bi crime to travel go Antarctica, correct informate show sey thousands of pipu dey visit di kontinent evri year.


This content was produced with support from the Independent Media Response Fund, an initiative of the Check Global Program at Meedan to respond to global challenges through hyperlocal initiatives. The fund is supported by the Swedish International Development Cooperation Agency (Sida). 

Share your love
Facebook
Twitter

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

7 − one =

Newsletter

Follow Us